Date: January 18th, 2018 7:59 AM
Author: misunderstood exhilarant patrolman legend
https://www.bbc.com/pidgin/tori-42720616
Government for UK don make new minister for loneliness, and her name na Tracey Crouch.
Madam Crouch say she dey proud to face di "generational challenge" to face issue wey dey affect about nine million UK people, weda dem young or old.
Di 42-year-old add say she go work with different political parties for dis work.
UAE don get first minister of artificial intelligence
Why Zimbabwe dey get 'Minister of WhatsApp?'
For statement na im Prime Minister Theresa May say di new post go work with do Commission on Loneliness, businesses and charities to make new government strategy.
Report from last year for UK say loneliness dey dangerous to health as e be to dey smoke 15 cigarettes per day.
(http://www.autoadmit.com/thread.php?thread_id=3863519&forum_id=2#35181856)